Friday, September 13, 2013

Animal or fruit?????? wonderful works from a photographer.

Make una look this collection of photo, very beautiful and creative, the thing remind me of wen I been small, I remember say my mama tell me, make I no use my food take play. Anyway. the works na from one French photographer, her name na Christel Jeanne and she name the work, "The Fruits Of My Immagination"  *First two Photos named by Tolotolo Longneck, oya make una name the rest.

Hollandia Fish

Paw paw fish








Tuesday, September 10, 2013

Meet Alonso Mateo, the worlds most stylish pickin.

Style, Swagger, poise, pose, this pickin wen be 5yrs old get everything, from Gucci, to Tom Ford, to  Dior to AllSaints this smally dey wear every, some people dey call am 'the mini fashion icon' this boy dey pose like adult model with experience, when dem ask him mama about her pickin, she say the boy love fashion die, and na only him dey choose wetin him dey wear, him career start when him mama upload one picture for instagram, and the rest na history.
   ( “I love suits, sneakers and sunglasses. I like to dress like my dad, because he has cool suits”,)  Alonso Mateo.





Disco for the dead, Expensive coffin with sound system.

Na wo o, Tlers, what will a man not hear, Person don make Designers coffin when get heavy sound system inside, dem say na make the dead for dey hear music, to make dem happy, the Coffin na almost five million nairia. The name of this coffin na CataCombo coffin, make una read the description from the company website....
'Employs a pair of 2-way speakers, divine tweeters with external cooling and one hell-of-a 8-inch subwoofer - fine-tuned to the coffin’s unique interior acoustic space.'  Kweke!!!
         Tolotolo longneck ask some people about this coffin, make una see wetin them get to talk.

Dele......End time tins!!!
Joshua......Wahala dey o. How will the dead hear when the trumpet sounds with all that music?
Pastor Efe.......Vanity upon Vanity all is Vanity what shall it profit a man...........

Saturday, September 7, 2013

Say hello to Pacu, the fish that eats human balls.

Make una no fear, the fish no dey Nigeria, but this fish wen dem dey call 'Pacu' aka the 'ball catter' dey chop men balls for Sweeden,  ("They bite because they're hungry, and testicles sit nicely in their mouth," ) said eloquent fish expert Henrik Carl of the National History Museum in Denmark.  So if you ever visit Sweeden here is a little advise to the men, NO SWIM, OTHERWISE YOU NO GO CARRY YOUR BALLS COME BACK.

Laugh one kill me for Akon real name.

TLers, i just copy say Senegalese American singer, Akon name na......Aliaune Damala Bouga Timeh Puru Nacka Lu Lu Lu Badara Akon Thiam.   Kweke!!!! One question for you Mr Akon, so why all this forming?????


See Timaya's little daughter.

Everybody know say Timaya get daughter, but some of una neva see her picture, trust tolotololongneck to bring you all the news when get juice, for free. This na picture wen Timaya post for him instagram page. Beautiful or not????

New Trend. Nigerian boys tattoo lips.

Boys for Nigeria dey tattoo their lips o! dem say girls dey like boys wen get pink lips, so dem don start to tattoo their lips permanent pink color, this is ridiculous.