Every body wen know me, know say I dey feel burna boy, I no be homo, I don fix month and day for my marriage to my girl fren for 30yrs, na only the year I never fix, as I fix that one finish I go let una know, I go invite una come, anyway back to the matter, my friends them for bella naija been follow burna boy reason, for the interview him yan many things, of how him take stat the music for port harcourt with him record label, before them come reason to enter lagos for the whole matter, him talk say him grand father na fela manger those times, and one person wen him dey feel na Shaba ranks, him still yan say him like to own oil block, but the one thing wen him talk wen I take know say him dey nack akpako, na wen he come say as e dey hot so, say him no they smoke again, my pepo make una help me reason wether na nock out him hold for this picture, abi na abisco.........because I copy say this picture neva tail.
No comments:
Post a Comment