No be small gbege (wahala) dey happen for Egypt, all this pepo for Egypt they vex, and their blood to they hot, since military snooker their president (Mohamed Morsi), na so so kpef (die) nai pepo dey kpef due to casala wen the thing cos, over 149 pepo don die, the pepo wen dey support the president wen them commot so, them no gree, them dey hold ground like hungry bingo wen hold bone, as the thing they hot so the interim government don place serious cofew for different places, and the vice president 'Mohamed El Baradei' don resign. Abeg make una pray for our African brothers.
-
Why
ReplyDeleteAfrica my Africa why?
ReplyDeleteToo bad
ReplyDelete