Wednesday, September 4, 2013

Incase u neva know #timaya's voice, Wizy Tiwa and Ice Prince, nominees for MOBO Awards.

Una know say our Nigerian Music industry dey catch fire. Ice prince win one award for BET as best African art for 2013, now MOBO award for UK dey nominate three of our own. Ice Prince, Tiwa Savage and Wizkid, for the best African art category.
Anyway Tiwa post something for her twitter page, i say make i follow una share, (you all know i am not stingy) make una wish dem luck!!!!!.





Sunday, September 1, 2013

kai, for the new kia nairo.

    
   
Kia new concept, i go bring una the price later, i neva dey sure for now, befor then make una read about the sexy moto.

 Butterfly doors for Kia Niro
Joining a string of aggressive hatchback concepts brought by the Korean automaker to recent European motor salons, Kia released renderings of its Niro Concept ahead of its debut in Frankfurt. The compact SUV employs a stainless-steel roof, butterfly-hinge doors, a 1.6-litre gasoline engine and an electric motor mounted at the rear axle, and retains Kia’s signature grille – an inheritance from lead designer Peter Schreyer. (Kia Motors)

I see you Pharell.

Pharell Williams (photo taken a few days ago)

Fake Hymens for sale. Girls can now by thier virginity back.

#Clearing throat. “Now women fit fake everything o! Men be carful, them don dey sell fake hymen, which means girls wen don loose their virginity since 1930, fit buy am back, this designers hymen just enter Abuja, and girls they buy am well well, because those when dey the business confirm say the thing they move. kweke!!!!! Tolotolo longneck ask some people wetin dem think for the matter, see wetin dem talk. Note(Contains vulgar words, for those above 18years of age only.)

Doctor Efeturi......"I think it’s to block the place, not necessarily to form a hymen. And forced entry will lead to slight bleeding".

Engr Triumphant.....At the moment I can no longer trust my girl friend o!"

Soldier Fidelis Alechenu,  “Fake character, fake hair, fake lashes, fake toto fake everything. This world don spoil finish.”

Saturday, August 31, 2013

Ghanian artist Reggie Rockstone don introduce new condom line.

 I dey house they relax when person bring Rocdoms for me, for those of una wen no know wetin e be,  Rocdoms na the name of the new condom wen Ghanian hip life pioneer Reggie Rockstone,  introduce, for him new condom line, everybody know say I am a blogger in the lord, and besides I don marry, so i no need that kin thing,  in my magnanimity I carry my own give the less privilege as I dey always do #smiling, make una see Reggie and pictures from the lunch.


Badest guy ever liveth Olamide, and the Ciroc Endorsenent deal.

Last time I tell una about Iyanya endorsement deal  with Zinox, Endorsement deals na wetin every celebrity dey hope for, because these deals dey make dem richer, and also show say dem dey relevant for the industry, we don see different companies like MTN, GLO, PEPSI, GUINNESS and many others sign deals with our Nigerian artist and entertainers, but this one wen Badoo Olamide sign na big one, because him don join the like of  Rick Ross, DJ Khaled, Ray Jay, and Funkmaster Flex as an ambassador for the alcoholic beverage, ciroc. Them no disclose the amount, but I copy say the money big well well, because na in three parts them take send the money come, Kpoko!!!
 Olamide dey drop correct jams, make hits, roll with the big boys(d banj) sign the endorsements and make the money, Olamide badooooooo!!! the dream of a ghetto boy.


Friday, August 30, 2013

Oya meet the man wen dey behind the big brother show John De Mol.

John de Mol na Dutch media tycoon, na the man wen create big brother, and him worth over $2.2 billion. Pepo they call am the  Reality TV pioneer, him na Oga for behind production companies wen them dey call Endemol and Talpa. He make him money from all this television shows  "Deal or No Deal," "Fear Factor," and "Big Brother."  Another one wen him dey do now na "The Voice," and them license am for 50 countries, including China where the show for dey get over 100 million viewers. This guy don still get another one wen dem they call "The Winner Is…" As of March 2013, Forbes name am  the 3rd richest man for him country Netherlands and the 670th richest man for the World. So whenever you they cry say your favorite contestant don commot, one man dey smile go bank, him name na Oga John de Mol.